If yu obey dem, God go keep en promise wey E make wen E tell mi sey, ‘My shidren-shidren go rule Israel as long as dem dey obey my kommand with all dia heart and soul.’
And naw, my Oga! Yu wey bi Israel pipol God, I dey pray make Yu do all di oda tins wey Yu promise my papa wen Yu sey, na only en shidren-shidren go bi king for Israel, as long as dem obey Yu, just as dia papa, David obey Yu.