18 Na for pipol present I go for do wetin I vow to God
I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.
I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.
So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
E betta make yu nor promise dan to make promise wey yu nor go fit keep or pay.