Dat kind juju bi like image for farm where dem plant melon put. Di juju nor dey tok; dem must karry am waka, bikos e nor get leg. But make una nor fear dem, bikos dem nor go fit wound or help una.”
Wen pipol si dis tins, dem dey bi like fool wey nor get sense. Doz wey dey make juju, na di juju dey disgrace dem; di gods wey dem make, nor bi betta god and e nor even get life.