So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.
Just to honor di Oga una God, make una dey celebrate di Passova evry year for Abib mont, bikos dat na di mont wey di Oga una God take karry una komot from Egypt for nite.