Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 111:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Evritin wey E dey do dey rite and good and pesin fit trust all en kommand,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 111:7
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E always dey keep en kovenant; di promise wey E make give 1,000 generashon.


But my Oga God, Yu dey near and all yor kommand na true


All yor kommand na true and all yor laws go last forever.


But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.


My God, yor word wey dey forever, stand gidigba for heaven.


God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.


God kommands dey rite and e dey put joy for pesin heart. En kommands dey klear and e dey give pesin hope to stay for dis world.


Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.


Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.


My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.


E don remember en promise to love and kare for Israel pipol and di whole eart don si God viktory.


But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.


Awa Oga God dey ready to ponish us and E really ponish us, bikos anytin wey E dey do, dey rite, yet wi nor gri listin to am.


Na-im bi di Rock; evritin wey E dey do dey korrect, bikos wayo nor dey en tins. En na God wey pesin fit bilive, bikos E nor just dey judge pipol anyhow.


Weda wi get faith for am or not, Christ go still bi who e bi and e nor go shange.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ