Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa.
Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.
Wen di sojas hear di ram horn sound, dem kon shaut well-well for war. Di town wall fall rish groun and di sojas run enter di town at wons kon win Jeriko pipol.