Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 111:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 111:4
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

If una turn back kom meet God, doz wey karry una relashon go prison, go pity and free dem. Di Oga una God dey sorry for pipol and if una turn back kom meet am, E nor go rijet una.”


God dey sorry and show mesi to pipol well-well; E nor dey kwik vex and en love for us nor dey fail.


Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet.


God get mesi and dey sorry for pipol! E nor dey kwik vex and en love nor dey ever fail.


Yet, God sorry for dem kon forgive dem dia sins and E nor distroy all of dem. So, E nor dey too vex for dem or show en vexnashon,


But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol; Yu nor dey kwik vex and Yu dey show yor faithfulnes and great love wey nor dey fail.


Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.


I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.


But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.


But God grace big well-well with faith and love wey dey for Jesus Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ