God dey make evritin happen for di rite time. Yet nobody go fit really undastand all di tins wey E don do and E put kweshons for awa mind about wetin don happen before and wetin go still happen.
E get anybody wey fit pak wota for hand kon measure am? Abi who fit measure di sky? Abi anybody don fit weigh all di san for di eart or weigh di mountins and hills with skale?
“Di sign dem wey E show us dey great well-well! Even en wonders dey mighty! God kingdom go dey forever and en pawa go last from awa generashon go rish di next one.”
Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.