Psalms 111:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
“En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’
“En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’
but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.
So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.”
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.