1 Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
My soul, make Yu praiz God! Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name!
Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good! E love wey nor dey fail, dey forever.
Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever! Make all di pipol sey, “Amen!”
Make dem praiz am for where pipol dey and for where di leaders for di nashon gada put,
My God, for evribody present, I go tank Yu. I go sing yor praiz among di nashons.
But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
Make wi praiz di Oga wey bi awa God kon sing new song to am. Make wi sing praiz am for where en pipol gada put.
Evribody wey dey fear God, kom make wi praiz am! All Jakob shidren-shidren, make una kom make wi honor am!
I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.
Den I go tank Yu for where yor pipol gada put. I go praiz Yu for all yor pipol front.
So my God, heavens go praiz di great and wonderful tins wey Yu don do and angels go praiz Yu bikos of how Yu dey good.
Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.
My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.