30 But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
Make dem praiz am for where pipol dey and for where di leaders for di nashon gada put,
Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
My Oga God, di king for di whole eart go tank Yu, bikos all of dem go hear yor words.
Den I go tank Yu for where yor pipol gada put. I go praiz Yu for all yor pipol front.
So, I go tank God, bikos E dey judge well; I go sing and praiz di Most High God.
My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
Jesus tell God sey, “I go announce yor name among pipol wey bilive and I go praiz yu for dia present.