Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 109:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 109:14
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”


Wen Atalaya, Ahazaya mama si sey en pikin don die, e kon kill evribody for di king family.


Bikos Ahazaya na family memba to Ahab thru marriage, en too sin against God, just like Ahab family.


Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.


Make Yu nor forgive di bad-bad tins wey dem do and nor forget dia sins, bikos dem don curse us wey dey build.”


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”


“Doz of una wey nor go die for una enemy land go waste trowey, bikos of una and una grand-grand papa sin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ