9 Bikos E dey give wota to pipol wey nid am and food to doz wey dey hongry.
I go bless dis town kon make am prosper. Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land.
Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison.
Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
My shidren, make una kom listin to mi and I go tish una how to fear God.
I go give good food to dia priests and my pipol go get evritin wey dem wont. Mi, wey bi God, don tok.”
Doz wey don taya, I go give dem wota drink kon feed doz wey don weak bikos of honga.
God go bless una wey dey like to do good tins, E go give una evritin wey una wont.
E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well, E don make dem poor.