So I ask, “Na who wise rish to undastand wetin make dis tins happen? Na who God don tell wey fit esplain why e bi like dis? Wetin make di land skata kon dry like desert wey pipol nor fit travel pass?”
If anybody won boast, make e boast sey e know and undastand mi, bikos my love dey forever and I dey do wetin dey korrect and true. I like pipol wey dey do dis kind tin. Mi, wey bi God, don tok.”
Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer.
Many pipol go dey klean; dem go klean dem well-well, but wiked pipol go still dey do dia wikedness. No wiked pesin go undastand naw, but na only wise pipol, go fit undastand.
Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.