Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 107:37 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

37 Dem plant seeds and vine for di land kon harvest plenty fruits and food.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 107:37
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.


Den Profet Isaya tell King Hezekaya sey, “Dis na sign of wetin dey happen. For dis year and next year, na food wey grow on en own, una go chop, but di year wey go follow dat one, una go plant and chop una food. Na so too una go plant vine and chop di grape.


My pipol go build house kon stay inside. Dem go plant vine kon enjoy di fruit and di wine.


‘Make una build house kon setol down, den plant seeds and chop anytin wey e produce.


Una go plant vineyard on-top Samaria hill again and di pipol wey plant dem, go chop from dem.


Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”


Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.


but E nor stop to do good for una, E dey give una rain from heaven and food from groun, so dat una go chop and belle go sweet una.”


Pesin wey plant and di one wey wota, nor mean anytin, bikos na God dey make di seed grow.


Bikos na God dey give seed to farmer and provide bread wey pipol go chop. Like dis too, E go provide and di tins wey una nid, go plenty well-well and dem go last forever.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ