29 God stop di wave for di sea and evriwhere kon kwayet.
Yu make di rof sea kwayet kon silent di nashons wey dey kause trobol.
Even pipol wey dey far from awa land, dey sopraiz for yor greatness and Yu make doz wey dey stay for east and west, praiz Yu.
Na Yu dey rule di sea and kontrol dia waves.
So dem trow Jonah inside di wota, den di breeze kon stop.
Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.