17 Bikos some nor get sense, dem kon tok against am and dem sofa for dia sins.
Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem nor good at-all and dia ways bad well-well. No one among dem dey do wetin good!
Who nor get sense nor go fit know wetin Yu dey do and na only fools nor go undastand sey:
Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
Small time, e bigin follow am like melu wey dem won go kill and like animal wey waka fast enter trap
and I si many men wey nor get sense, but I notis one among dem wey foolish well-well.
Na di wiked tins wey una do go ponish and kondemn una, bikos una turn from mi. So, una go learn as e betta and wiked rish nor to dey fear mi or forget mi wey bi di Oga una God.” Mi, wey bi God, don tok.
Den, why wi human being go dey komplain if dem ponish us for awa sins?