E still dey tok to dem wen di pesin wey dem send, kom tell am, “Di king sey, ‘Na God dey kause all dis wahala for us! Wetin go make mi still dey wait make E kom help mi?’ ”
Di king wey Yu put ova us, bikos wi sin, na-im get evritin wey di land dey produce. Na wetin dem like dem dey do with wi and awa animals and wi really dey sofa for dia hand.
Di same tin don happen naw for Babilon, una don bi slave and dem nor pay anytin for una head. Pipol wey dey rule una dey make mout and dem dey always use my name make yeye.
den e pray sey, “My God, make Yu allow mi die with Filistia pipol wey bi my enemies.” Den di temple fall skata for di five rulers and di pipol head. Di pipol wey Samson kill wen e dey die, many pass di ones wey e kill wen e dey alive.