10 Some sidan for where dark pass and dem shain dem with iron,
So God kon allow di oga for Assyria sojas attack Judah. Dem seize Manasseh, hook en nose, tie am with bronze shains kon karry am go Babilon.
Make darkness and deat shadow kover am! Make betta kloud dey on-top am; make darkness kover en lite.
Di shain for Josef leg kon dey pain am and dem put iron for en neck.
Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.
Pipol wey dey waka for darkness don si lite. Lite dey shine for doz wey dey stay for di land where strong darkness dey.
So my enemies, make una nor happy, bikos of mi! Bikos wen ever I fall, I go raiz-up again. Even doh I dey for darkness, Oga God go bi my lite.
“Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
una wey dey darkness, don si big lite and una wey don nearly die, don get life.”
so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness and where deat dey. Den God go give us peace.”