Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 107:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 107:1
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una tank God, bikos E dey good, en love go dey forever.


Odas wey join dem na: Heman, Jedutun and di odas wey dem choose to dey praiz God, “Bikos en love dey forever.”


Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”


Doz wey dey blow trumpet and doz wey dey sing kon dey sing togeda dey praiz and give God all di glory. With di trumpet, cymbals and oda instruments, evribody kon dey shaut praiz God dey sey: “God dey good! En love and goodness, na forever and ever!” At wons, one kind tick kloud kon kover God Temple.


Wen evribody for Israel si sey fire kom down and God present full di temple, dem knee down kon face groun. Dem kon dey woship and tank God dey sey, “True-true, God dey good; en love wey nor dey fail, go dey forever!”


Di priests stand for where dem put dem, plus all di Levi pipol wey dey play music to take praiz God. (Dis na di tins wey King David make to take give God tanks and David dey use dem wen ever e dey praiz God sey, “True-true, yor love dey with us forever.”) Di priest stand near Levi pipol dey blow di trumpets, while evry oda tribe for Israel, stand dey praiz God.


Bikos God dey good, en love wey nor dey fail dey forever and E dey good from one generashon go rish anoda.


But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;


Make wi tank Oga God! Make wi koll en name kon tell di whole world about di tins wey E don do.


Make wi praiz God! Make wi tank am, bikos E dey good! E love wey nor dey fail, dey forever.


Make wi tank God, bikos E dey good and en love dey-dey forever.


Yu dey good and na only good tins Yu dey do; so make Yu tish mi yor kommand!


Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”


E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ