43 Even doh God save dem many-many times, dem still choose to sin against am and dia sin kon finally distroy dem.
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
Dem make God vex with all dis tins, so wahala and diziz kon attack dem.
bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok
So I let dem do di tins wey dey hongry dem to do kon live dia life di way dem wont am.
Sidon, Amalek and Maon pipol, opress una before and wen una kry give mi, I nor kom save una from dia hand?
Den war start for di town bikos Israel pipol bigin serve oda gods. But e get any man for Israel among di 40,000 men wey karry shield or spear go fight?
Dem go kom with dia kattle and tent wey tick like lokust. Dem go use dia kamel take skata di land
and Israel pipol nor fit do dem anytin.
E nor get anybody wey fit do iron work for Israel, bikos Filistia pipol nor wont make Israel pipol dey make swods and spears.