40 and na dis make God leave en pipol wey bi en special propaty.
Na Israel enemy e bi thru-out di time wey Solomon bi king.
My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?
God still sey, “I don forget Israel pipol and rijet di nashon wey I choose. Doz wey I love, I don give dem to dia enemies.
God rijet en own altar kon hate en temple. E allow enemies distroy di walls and dem kon dey shaut inside di temple like sey dem dey do party.
Di pipol wey I dey porshu komot from di land for una, make una nor follow dia laws, bikos I nor like all di tins wey dem dey do.
I go distroy di place where una for dey woship on-top di hills kon skata una incense altars, den kill and trowey una dead body near una juju wey don fall. I go rijet una finish.
Na one mont I take kill di three oda shepad wey hate mi, bikos I nor like dem too.
So wen God si all dis tins, E vex bikos en shidren dey disobey am.
Dem bi yor pipol, yor betta propaty wey Yu take komot Egypt with yor great strent and pawa.”
Bikos of dis, God vex well-well for dem, so E let tif karry all wetin dem get. E allow dia enemies opress dem and dem nor fit protet demsef again.
So, God vex well-well for dem kon sey, “Bikos dis pipol don break my kovenant wey I make with dia grand-grand papa and forget my kommand,
So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.