Instead, I warn di yong pipol wey dey with dem sey: ‘Make una nor follow di laws wey una papa dem make or follow wetin dem dey do or serve di juju wey dem dey serve.
Den una go remember all di yeye tins wey una do and di bad ones wey una do with una body. Una go vex for unasef, bikos of all di bad tins wey una bin do.
Tell di town wetin mi God wey get pawa dey tok: Bikos una don kill many of una own pipol kon make unasef dirty as una dey serve juju; I go soon get una time.
“Man pikin, wen Israel pipol bin dey dis land, dem spoil am with di way dem dey do and bihave. I si sey dia karata nor dey good and klean and bi like woman wey dey si en period.
“Israel pipol, make una stop to celebrate una festival like doz wey nor know God. Una don turn from una God and nor dey faithful to am again. Una don sell unasef give juju like ashawo wey dey di land and una love wetin una tink sey love una.