Even till today, dem still dey offa di same sakrifice and dey distroy demsef with di juju, bikos dem dey burn dia shidren for fire gi-am as sakrifice. Den Leta, una go still kom ask sey wetin I wont! But as long as I bi God wey get pawa and di God wey nor dey die, I nor go let una ask mi anytin.