33 bikos dem make Moses vex and e kon dey tok like fool.
Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”
But Job tell en wife, “Wetin make yu dey tok anyhow! Wen God give us good tins, wi take am. So naw wey trobol dey, make wi kon curse am?” Even as all dis tins dey happen so, Job nor sin or curse God.
“Who yu bi to kweshon my wisdom with yor empty words?
bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok
My God, make Yu help mi kontrol my mout kon guide my lips.
I tell mysef sey, “I go dey kareful for wetin I dey do and I nor go sin with wetin I dey tok. I go hold my tongue wen sinnas dey near mi.”
Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.
bikos wi dey make many mistake. If pesin nor dey make mistake for wetin e dey tok, dat mean sey e dey pafet and e go fit kontrol en body.