7 Na-im bi di Oga awa God. Pipol dey si di way E dey judge for di whole land.
“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
Make una know sey na di Oga God bi God! Na-im make us and wi bi en pipol. Wi bi en pipol, di sheep wey dey en field.
bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.
“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave.
I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.
Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”