21 and Fero make Josef oga for evritin wey dey en house; so Josef kon bi oga for evritin wey di king get.
Wen evribody for Egypt don dey sofa, bikos of di honga, di pipol kon kry go meet Fero make e give dem food. But Fero tell dem, “Make una go meet Josef and anytin wey e tell una, make una do am.”
Dem tell dia papa, “Josef neva die and na en dey rule Egypt!” Jakob kon sopraiz, bikos e nor bilive dem.
So naw, nor bi una send mi kom here, but na God. E don turn mi to Fero adviser, di oga ova all en propaty and di ruler for Egypt land.