2 Make wi sing to am. Yes! Make wi sing to am. Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
Dem always dey my mind and I nor fit stop to dey tink about di mighty tins wey Yu do.
My God, yor ways dey holy. E get any god wey get pawa like Yu?
Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand.
Make dem sing dia praiz give God with harp, sweet-sweet songs,
“Wen una son ask una for future sey, ‘Wetin dis tin mean?’ Una go ansa, ‘Na with mighty pawa God take komot us from Egypt where wi for bi slaves.
Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.
Una wey bi king, make una listin! Una wey bi rulers, make una hear mi! Bikos I go sing and play music give God, di Oga for Israel.