Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 105:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 E kause honga for Kanaan land wen E nor make di groun bear betta food for dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 105:16
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

And di seven years for honga kon start just as Josef tok sey e go bi. Honga dey for di whole world, but food dey for Egypt.


But food nor dey di land again, bikos di honga for evriwhere, strong well-well. So pipol kon die anyhow for Egypt and Kanaan land, bikos food nor dey.


Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”


So Elisha advise di Shunem woman wey e wake en pikin from deat sey, “Make yu and yor family go stay for anoda place for sometaim, bikos God don sey honga go dey dis town for seven years.”


wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.


Naw, di Oga God wey get pawa won remove evritin and anybody wey Jerusalem and Judah pipol dey depend on. E go still remove dia food, wota, guards,


God still sey, “Man pikin, I go remove bread from Jerusalem. Di pipol go dey measure di food and wota wey dem dey drink, so dat e nor go finish.


Una nor go get food to chop and ten wimen go dey bake all dia bread wey dem get for only one oven. Dem go share am and afta una don chop finish, una go still dey hongry.


Pipol nor dey fear, if dem blow war trumpet for di town? Abi wahala dey just happen for town, wen God nor allow am?


Even wen I send hot breeze and big-big stones kom skata evritin wey una plant, una nor still gri turn from sin kom meet mi.


Honga kon dey for di whole Egypt and Kanaan and awa grand-grand papa dem nor si food chop.


So I look kon si one horse wey en kolour bi like green wey don dey fade! Di pesin wey dey ride am, na Deat dem dey koll am and en friend na di Grave. Wen dem divide di eart into four, dem give di two of dem pawa ova one part, so dat dem go kill pipol with dia swod; honga; diziz and wiked animals.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ