Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 105:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 “Make una nor tosh dis pipol wey I choose and make una nor plan to do bad tins against my profets.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 105:15
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw, make yu give di woman back to en husband, bikos true-true Abraham na profet and e go pray for yu and yu nor go die. But if yu nor gri give di woman back to en husband, make yu know sey yu must die with evritin wey yu get, even all yor pipol.”


So Abimelek kommand all en pipol sey, “Anybody wey tosh dis man or en wife, must die.”


David ask am, “Wetin make yu nor fear to kill di pesin wey God choose?”


Wen King Jeroboam hear dis tin, e point kon sey, “Make una hold dat man!” At wons, di king hand paralaiz and e nor fit strait am again.


Make yu still anoint Jehu wey bi Nimshi pikin, as Israel king. Den yu go anoint Elisha wey Shafat born, wey kom from Abel-Meholah, bikos na en go bi profet afta yu.


Haman kon tell en wife Zeresh and all en friends evritin wey happen to am. En friends with en wife Zeresh kon tell am, “Yu don dey luz pawa to dis Mordekai. E bi Jew pesin and yu nor go fit win am. True-true e go win yu.”


Den e tell Jerahmeel wey bi en pikin, Seraya wey Azriel born and Shelemaya wey bi Abdeel pikin sey, “Make una go arrest Jeremaya and en seketry, Baruk, kom.” But God don hide dem.


E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.”


Judah go bi God special propaty for en holy land again, den Jerusalem go bi di town wey God choose.


Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.”


As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ