11 “I go give una Kanaan land and e go bi una special propaty.”
God appear to Abram kon sey, “I go give dis land to yor shidren-shidren.” So Abram build one altar to God wey appear to am for der.
All di land wey yu dey si so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren forever.
Dat day, God kon make kovenant with Abram sey: “From Egypt borda go rish Eufrates River, I promise to give all dis land to yor shidren,
den Oga God stand for di top. God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.
E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.
I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’