10 E give di promise to Jakob, just as E kommand and for Israel pipol, na kovenant wey nor dey end, bikos E sey:
Na so God go take bless my shidren-shidren, bikos E don make kovenant wey go last forever with mi: agriment wey nor dey break and promise wey nor dey shange. Na wetin go give mi viktory bi dat and God go make am happen.
God wey get peace, di Pesin wey use di everlastin kovenant blood bring awa Oga God Jesus Christ kom back from deat; awa Oga God wey dey look di sheep,