29 Wen Yu nor ansa dem, dem go dey fear. Wen Yu remove life from dem, dem go die kon turn to san.
Yu go sweat before yu chop, until di day wey yu go die go back to groun, where I from kreate yu.”
Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again?
Why Yu dey hide from mi? Why Yu dey trit mi like sey I bi yor enemy?
If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.
Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
But my God, wen yor favor don sikure mi like mountin, Yu kon turn from mi and evritin wey I get kon skata.
Yu make human being go back to san where Yu from kreate dem wen Yu sey, “Make una go back to where I for kreate una!”
By den, yor body go-go back to groun where e from kom, while di spirit go-go back go meet God wey bin gi-am to yu.
and E nor wont make human being gi-am sometin like sey E nid anytin, bikos naim dey give life and air wey wi dey breath.
For dat time, I go vex for dem well-well kon leave and hide my face from dem until dia enemies kill dem finish. Many wahala and trobol go ovakom dem and dem go sey, ‘Dis wahala don finish us, bikos God no dey with us again.’