27 All wetin Yu kreate dey wait for Yu to give dem food wey dem go always dey chop.
And yu go take and gada evry kind food enter inside di boat, so dat una go dey si food chop.”
Dis na how E dey feed and provide plenty food for pipol to chop.
Na who dey feed raven bird wen dem dey waka dey find food for evriwhere? Even wen dia small shidren dey kry give mi sey dem dey hongry, na yu dey feed dem?
Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.
Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.