God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
Na snake play wayo pass any wiked animal wey God kreate. So di snake tell di woman, “Na true sey God sey, ‘Make una nor chop from all di tree wey dey di gardin’?”