Na only Yu bi God. Na Yu kreate di heaven and di stars for sky. Yu kreate land, sea and evritin wey dey inside, den kon give dem life. All di pawa for heaven, dey bow woship Yu.
My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.
E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.