Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 104:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Even lions dey kry bikos of honga and dem dey ask God for dia food,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 104:21
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na yu dey give lion food make dem chop, or dey make small lion beleful


Na who dey feed raven bird wen dem dey waka dey find food for evriwhere? Even wen dia small shidren dey kry give mi sey dem dey hongry, na yu dey feed dem?


So my God, evritin dey look up to Yu and Yu dey give dem dia food wen dem wont am.


E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.


Yong lions wey strong well-well still dey hongry, but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.


True-true, dis na wetin God tell mi, “Like lion wey dey shaut with vexnashon or yong lion wey won chop wetin e kill, na so I go bi like. Even doh many shepad gada round di lion, e nor dey fear dia shaut or run from dem. Na like dis too, Oga God wey dey lead heaven sojas, go kom help Mount Zion.


All di melu dey kry bikos dem dey hongry and grass nor dey for dem to chop. Even di sheep demsef dey sofa.


Even wild animals dey kry, bikos no wota to drink for anywhere and fire don burn all di grass finish.


Make una animals nor fear. Di field go get grass; di trees go bear dia fruit and fig and grapes go plenty well-well again.


Lion dey shaut anyhow wen e nor katch animal? Or small lion dey karry shaut wen e nor dey chop?


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ