11 As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.
God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.
But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren;
Bikos E love us with di love wey nor dey fail and God goodness dey last forever. So make una praiz God!
Yu dey guide and hide dem for yor present and dia enemies nor go fit tosh dem or lie for dia head.
My God, yor love wey nor dey fail, big and wide like di heavens; just as yor goodness high pass di kloud for sky.
Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven. Yor faithfulnes dey rish di kloud.
Yor love wey nor dey fail go last forever. Yor goodness dey forever like di heavens.
Nobody fit know wetin kings dey tink. Just as sky high well-well and as sea deep rish, na so too dia mind bi.
As heaven high pass di eart, na so my ways and di way I dey tink, high pass una own.
E dey show en mesi to evribody wey dey fear am for evry generashon.