27 But Yu go always bi who Yu bi; Yu go dey forever.
“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.
To Yu, one tazon years bi like one day or like some hours for nite.
“Na mi bi God and I nor dey shange. Una wey bi Jakob shidren, na mi make una neva die finish.
Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!”
Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.
God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”