My Oga God, di Pesin wey dey holy, Yu wey dey since and go always dey. Oga God wey bi awa Rock, Yu nor dey plan to kill us finish, Yu only send Babilon pipol to kom korrect and ponish us bikos of awa sin.
Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front