Make Yu listin to di prayers wey mi and yor savants wey dey honor Yu, dey pray. Make Yu help mi today, so dat di king go sorry for mi.” For dat time, na mi dey serve di king wine.
My Oga God, make Yu look mi kon hear my prayers for yor savants, Israel pipol, both for day and nite. I konfess sey wi, Israel pipol don sin. Wi and awa grand-grand papa dem don sin.
I ansa dem, “God wey dey heaven go give us viktory. Wi bi en savants and wi go start to build. But una nor get rite, share or anytin to klaim for Jerusalem.”
But wen my savant tok wetin go happen; wen I send my messenjas go tell una wetin I plan, I dey make doz plans, happen. I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again and dem go ribuild Judah town. Even doh dem skata am before, I go raiz am up again.