Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.
Dem kon tell mi, “Tins hard for di pipol wey kom back. Dem dey for big trobol and disgrace. Dem neva fit ribuild Jerusalem wall and di gate wey awa enemies burn, still dey groun.”
Den I leta tell dem, “Make una si di kind trobol wey wi dey face, bikos Jerusalem don skata and en gates don distroy! Make wi ribuild di town wall, so dat shame go komot from awa eye.”
so I tell di king, “My king, make yu live forever! Wetin nor go make my face look like who dey sick wen e bi sey dem skata and burn di gates for di town where dem beri my grand-grand papa put.”
For en friends and Samaria pipol front, e kon sey, “Wetin dis yeye Jew pipol tink sey dem dey do? Dem one build di town again? Dem tink sey, na to offa sakrifice dem go take build di town finish one day? Dem go fit make stones from di ashes of di tins wey fire burn?”
I go sorry for Jerusalem and evribody wey dey stay di land wey dem skata. Even doh en land na desert, I go turn am to gardin and e go bi like Eden gardin. Joy and happiness go dey der and dem go sing songs take praiz and tank mi.
Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.
So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.