God wey bi awa grand-grand papa Abraham, Isaak and Jakob God, make yor pipol always dey ready to obey Yu forever, so dat Yu go always make dem dey faithful to Yu.
Na so too di Holy Spirit dey help us bikos wi dey weak. Bikos wi nor know wetin wi suppose to pray for, di Spirit by ensef dey kry beg God, for di way awa word nor go fit esplain.
But E give us plenty grace. Na dis make God word sey, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipol wey dey put dia body down.”
For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.