9 Anytin yu tell wise pesin go make am wise more-more. Anytin yu tell raitious pipol go give dem undastandin.
Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
Wise pipol dey kollect all di wisdom wey dem fit get, but wen yu hear foolish pipol dey tok, yu go know sey trobol nor dey far from dem.
Wen wise pesin advise pesin wey ready to listin, wetin e tok, betta pass fine gold ring or necklace.
So make wi serve God. As far day dey break and rain dey fall for di eart, E go kom save us.
But make una grow inside di grace wey awa Oga God and Savior, Jesus Christ give una, so dat una go know am more-more. Make glory bi en own, naw and forever! Amen.
I don rite all dis tins give una wey bilive God Pikin, so dat una go know sey una get life wey nor go end.