7 If yu korrect proud pipol, dem go curse yu! Anybody wey try to tok to wiked pipol, dem go still curse am.
Wen Ahab si Elijah, e tell am, “Na yu really bring dis wahala kom Israel?”
Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.
Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”
Una go tell dem make dem put am for prison kon gi-am bread and wota till I go kom back.”
But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.
Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.
Pikin wey get sense dey listin to en papa and mama word, but doz wey dey foolish, nor dey take korreshon.
Doz wey dey laf pipol nor dey like korreshon, so dem dey run from wise pipol.
Make yu nor try to tok sense give foolish pesin, bikos e nor go value am.
Di pipol no tok at-all, bikos King Hezekaya don tell dem make dem kwayet.