6 Make una komot from where fools dey and una go get life. Make una kom follow wisdom waka.”
Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.
All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.
Pipol wey dey listin if dem korrect dem go get long life, but doz wey nor dey gri sey dem dey wrong, dey waka lost.
Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
Listin my pikin; make yu get sense and tink how yu dey live yor life.
I don tish yu wisdom and di korrect way to live yor life.
Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.
Wisdom go add more years to yor age.
Dat time, dem go keep my law and obey my kommand with all dia heart. Dem go bi my pipol and I go bi dia God.
“Na from my savant David house, dia king go from kom. All of dem go dey happy under one king and dem go obey and respet all my laws.
“Make una struggol well-well so dat una go fit pass di small door, bikos many pipol go try to enter God Kingdom, but dem nor go fit.
As Pita dey tok to di pipol, e kon warn dem, “Make una save una head from di ponishment wey dey kom meet wiked pipol.”
Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una
Den I hear anoda vois from heaven sey, “My pipol, make una kom out from am, so dat una nor go follow am kommit sin kon sofa di same ponishment.