Wen Josef si Benjamin with dem, e kon tell en savant wey dey kare for en house, “Make yu take dis men go my house, den make yu kill one animal kon kook am, bikos dis men go chop with mi dis aftanoon.”
For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.