6 Make una listin to mi! I get betta words to tell una and na di rite words I dey tok so.
Bikos wetin I dey tok, dey good and wetin I dey tish, dey give pipol wisdom.
I go dey proud wen I hear yu dey tok with wisdom.
Remember evritin wey I dey tish yu, bikos dem dey good.
E do am so dat wetin di profet tok, go happen: “I go open my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”
So di sekret wey E hide from awa grand-grand papa dem and evribody wey dey di world before, E don open am make en pipol si.