5 Una wey nor know anytin, make una get wisdom. Una wey nor wise at-all, make una try get sense.
God laws dey korrect and e dey save life. Di laws wey God give us na trut and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.
But una wey bi fool, make una tink again! Wen una go really get sense to undastand?
Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem.
Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense and e go tish yong men how to work and get money.
Pipol wey wise go get good name, but fools go only add trobol join dia disgrace.
I bi wisdom and I get sense well-well; I still get knowledge and I dey judge well.
“Wi dey beg and koll evribody wey dey di world.
“Pipol wey nor know anytin, make una kom inside!” Den e tell doz wey foolish sey,
God dey go fight war like strong soja; E dey ready to fight. E go shaut. Yes! E go shaut for war kon distroy and win en enemies.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
Wetin di world tink sey nor good, naim God choose; tins wey dem tink sey nor mean anytin, na doz tins E make important.