33 Make una listin to wetin I dey tish una kon get sense. Make una nor rijet dem.
e dey shaut dey koll dem from di town gate and anywhere wey pipol gada put.
Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,
If yu nor like korreshon, na yorsef yu dey do; but if yu listin to korreshon, yu go always dey undastand.
If yu dey listin to advise and dey ready to learn, yu go wise one day.
My pikin, make yu listin to wetin yor papa dey tish yu; put yor ear down and yu go undastand.
My pikin, make yu listin to my wisdom and put yor ear down for di words wey I dey tish yu.
Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?